By Karen James
Na today 25th May 2025, wey Oga Police Oga – CP Ikioye Orutugu fwc MNIPS PhD – stand gidigba clap for Awka people say dem sabi celebrate without wahala! As Imoka Festival take end like Sunday rice, no single gbege report enter Police station – not even small quarrel over palm wine!
Di CP say di way Awka people carry sense join culture this year na 5-star behaviour. No fight, no snatching of phone, no “hold am, thief!” – just pure dance, enjoyment and correct respect for law and order.

E still hail other security people like FRSC and NSCDC wey help make sure say road no jam like Lagos hold-up and nobody carry celebration turn street fight. Normally, dem don dey expect some agberos to show madness under festival disguise, but this time around, everybody gentle like goat wey just chop grass.
CP Orutugu come use style yan say im administration dey open ear like satellite dish – anybody wey get beta info to help maintain peace, make dem no dull, just talk. Together, we go turn Anambra to the Dubai of Nigeria – with culture, peace, and correct jollof security.
Awka people, una do well – next festival, make una still maintain this “zero-wahala” record, abeg!