By Karen James
Awka/Onitsha – Na celebration full ground as Keke riders for Awka and Onitsha don begin dance shaku-shaku for road. Why? Because touts wey dey disturb dem life before don finally waka go! Thanks to SASA and their correct Oga, Hon. Monday Nwokoye, wey no gree play with any agbero matter.

One of di happy Keke riders, Mr. Uche Nwafor, yan tori people say:
“In fact, na big kudos to SASA MD, Hon. Monday Nwokoye! That man no dey joke at all. Him dedication and commitment na 100%. We Keke riders dey proud of am well well. And we dey thank our Governor for giving us better man like this to lead SASA.”
Uche say e still dey shock am say Onitsha, wey before be like action film, don turn peaceful place.
“I no believe say Onitsha fit calm like this. Awka too! Everywhere now na SASA, with better talk and serious action to end all this tout wahala for Anambra.”
Now, Keke riders dey waka freely, no more illegal levy, no more slap from random tout, and no more ‘park here’ drama. People dey wave for road, business dey move, and happiness dey sweet everybody like zobo for hot afternoon.
Hon. Monday Nwokoye and him SASA team don really show say if government serious, peace go reign. As dem go say, “SASA enter, touts scatter!”
So if you dey ride Keke for Anambra now – shine your teeth, blow your horn, because everywhere don set like Sunday rice!