By Karen James
Na hot gbege wey shock Anambra people again o! But this time, Police don enter action kampe! Dem no gree make the matter just waka go like dat.

According to correct tori wey land for our news desk, Anambra State Police Command don arrest two suspects wey dem say dey involved for the kidnap and killing of one fine female Bank Manager, even after dem don collect ₦14 million ransom from her people.
Who Dem Catch?
Dem two suspects na:
- Monday Egbe, 32 years
- Kenneth Nnoga, 28 years
Police track dem reach their hideout for another state, and gbam! dem land them for cell.
Di sad incident bin shelle for 13th January 2025, when dem find the madam body for Nnobi Road, eyes tied like say na film, after her people don drop N14 million for the kidnappers.
SP Tochukwu Ikenga**, the Police PRO, yarn say dem never stop the investigation. The suspects dey face serious interrogations now, and Police dey work to fish out other bad gang members wey still dey hide.

The Commissioner of Police, CP Ikioye Orutugu (fwc, MNIPS, PhD), don swear say the Police go continue to protect Ndi Anambra and ensure say justice go land gidigba for this matter.
Message to Criminals: Your Cup Go Soon Full!
Na so we see am o! We go still dey follow the matter. No go anywhere!
Stay tuned with Pechilly Investigative Media — where truth no dey hide!